fbpx
May 5, 2024

No put old Naira Note for ATM again – CBN

The Central Bank of Nigeria (CBN) don throw warning give all commercial banks for Nigeria say may dem stop to dey put old Naira note inside ATM Automated Teller Machines (ATMs). CBN tell the bank say make dem follow the instruction wey dem give banks to dey load the new naira note inside the ATM Automated Teller Machines (ATMs) not the old naira note.

Person wey be the CBN Director on Currency Operations, Mr Ahmed Umar, nah him yarn this talk for Abuja on Monday, Jan. 9 say may commercial bank stop to dey put old naira note for ATMs.

NEWS NAIRA NOTE/OLD NAIRA

Umar, yarn shook mouth for the matter during a Training Session for State Directors, National Orientation Agency (NOA) on Redesign of Currency Notes Policy, said dem don warn all commercial banks say make dem stop to dey put naira old notes inside ATMs or face penalty.

WETIN CBN OGA TALK ON NAIRA NOTE

Oga Umar, don yarn say CBN’s go make sure say by January 31st 2023, dem go don withdrawal all the old naira notes wey dey circulation finish. Umar add join am say: “We, CBN management, we don compulsory am for all banks wey dey use ATM say na only new note may dem dey put for the machines so that old naira note go fit komot for circulation.

Wetin people dey reason on the naira note matter;

Mezmiroon; On the old naira note matter wetin we need na the redesign of our economy and not the naira note. May Government to office for airport where only those wey dey travel with dia document complete for fit buy foreign currency wey dem need.

Prince Gozel: Atleast wey know say FG no want wicked and criminal politicians to bribe voters with the old naira wey dem don keep for house

You go like read: Bandit kpai Seven NSCDC officers, five others