fbpx
May 5, 2024

Woman N600k disappear from her bank account

woman-N600k-disappear-from-her-bank-account

Another video capture di moment wey one woman create big scene for di reception hall of one Nigerian bank wey dem shared online. Di woman N600k disappear from her bank account, na hin make her dey cry for di bank make dem return her money.

Di woman enter di bank go ask for refund after di bank debit N600,000 from her account without any reasonable explanation.

For inside di viral clip, di woman yarn say she don dey save her money for house and armed robbers neva come thief di money from her.

FOR MORE NEWS: Child law no dey Nigeria? – Viral video matter

Na after she decide to deposit di money for bank wey she feel say e safe pass to save money, Di woman N600k disappear from her bank account and according to her,na all her life savings be that.

Di woman just dey waka up and down, she no wear sliippers inside di banking hall. She dey cry make di bank return her money.

On top di matter, none of di bank staff make move to calm or attend to di woman.

You go like go read di full tori…READ MORE