fbpx
May 18, 2024

Barbie movie don make history as e surpass $1bn box office sales

barbie-don-set-new-record

Viral blockbuster movie, Barbie don set new record as e reach $1.03 billion worldwide so far following di release three weeks ago, according to reports wey official Warner Bros release.

And as e be so, e don make di film writer and direct, Greta Gerwig di first female movie director wey don shoot a billion-dollar movie.

According to Dergarabedian, a senior media analyst at Comscore, only about 50 movies for history, na hin don hit di billion-dollar mark.

In addition, Dergarabedian yarn say di first hint wey show say di Barbie movie go be record breaker na when dem dey do marketing campaign.

 

FOR MORE NEWS: Enugu Govt don ban unauthorised use of vehicle with tinted glasses

 

According to wetin hin tok, “di marketing campaign for ‘Barbie’ na hin  motion a chain of events wey led to di word ‘Barbenheimer’ wey dem add to di popular lexicon by virtue of di fact say dem share di same release date with ‘Oppenheimer,’ and na dat time all of dem know say something very special and unique go create a bigger than expected outcome for the film. And dem dem know say e no go be only for di opening weekend, but for di global run for theaters.”

You fit go read di tori see as Barbie don set new record …READ MORE