fbpx
May 18, 2024

Enugu Govt don ban unauthorised use of vehicle with tinted glasses

enugu-government-ban-unauthorised-tinted-glasses

Di Enugu State Government don ban unauthorised use of vehicles with tinted glasses to fight di disgraceful activities of kidnappers and other criminal elements for di state.

Na for inside statement di tori dey, and e dey issued and signed by di Secretary to di State Government (SSG), Prof. Chidiebere Onyia for Enugu.

He yarn say di ban go take effect after four weeks from di notice, with consequent enforcement starting from Sept. 4.

Di statement tok say di notice na to give owners of vehicles with tinted glasses, wey no obtain Police Tinted Permits before di suspension of di issuance by di Nigeria Police Force on June 7, 2021, enough time to comot am or replace am if e no dey factory fitted, in accordance with di provisions of di law.

 

FOR MORE NEWS: Ogunbote: Shooting Stars go do well next season

 

Also, vehicles wey no comply go enter wahale with enforcement taskforce and di vehicles no go dey released to dia owners until di tinted glasses dey removed or replaced and dem go pay fine join. Na warning wey hin give be dat.

Onyia still repeat am say di purpose of di ban na to monitor di activities of criminals and to generally enhance di security and safety of di good people and residents of Enugu State.

Finally, hin beg for di understanding and cooperation of di general public in dis regard.

You fit go read di tori see why Enugu Government wan ban tinted glasses…READ MORE