fbpx
April 29, 2024

Bauchi police don give assurance of better security for gubernatorial elections

bauchi-police-don-give-assurance

Di Bauchi State Police Command, on Wednesday, assure di pipo of di state of better security during and after Saturday gubernatorial and state House of Assembly elections.

Also, di command reveal say dem don mop up some illegal arms and ammunition for di state ahead of di elections.

Police spokesman for di state, Ahmed Mohammed Wakil, tok am for inside press release wey hin sign for Bauchi. Hin yarn say di command don receive some logistics support, including Armoured Personnel Carrier (APC), 37/38mm anti-riot guns, long and short-range shells, as well as two pick-up vehicles, from di Inspector-General of Police.

Di police spokesman yarn say di operations don make dem recover up to 23 illegal firearms from di hands of pipo wey dey behave anyhow.

According to di Police Public Relations Officer (PPRO), di weapon wey dem recover na : nine AK47 rifles; seven assorted locally-made firearms;
one Light Assault Rifle (LAR); six Dane guns, alongside 18 rifle magazines, while a total of 87 rounds of live ammunition of different calibres.

He yarn say di live ammunition wey dem recover na 22 rounds of live 7×62.51mm NATO ammunition; nine (58) rounds of live 7×62.39mm ammunition;
seven 9mm live ammunition; four machetes; one knife, and three military camouflages.

Wakil, a Superintendent of Police (SP), however, add say di state Commissioner of Police, Aminu Alhassan, don direct all Area Commanders, DPOs and Tactical Commanders for di state make dem sustain aggressive stance on cannon-fodders under any guise wey person fit don employ to obstruct di smooth and peaceful process of di 2023 gubernatorial general elections for Bauchi State”.

You fit go read di full tori…READ MORE