fbpx
May 5, 2024

Bayelsa APC chieftains dey vex over Jonathan alleged attempt to nominate minister

bayelsa-apc-express-disapproval

Stakeholders of di All Progressives Congress ( APC), for Bayelsa State don express dia disapproval over wetin dem describe as “relentless attempts by former President Goodluck Jonathan to nominate di state’s ministerial slot for President Bola Tinubu forthcoming cabinet.”

Di stakeholders under di auspices of di Bayelsa APC Elders Council, yarn say e surprise dem to see why Jonathan dey try to produce  minister after actively and openly supporting di candidate of hin Peoples Democratic Party (PDP), Alhaji Atiku Abubakar.

Speaking in Yenagoa, di state capital on Tuesday, Chairman of di council, Chief Michael Adomokeme, yarn say e dey wrong for Jonathan to try to reap where hin no sow.

 

FOR MORE NEWS: Sit-at-home order: Enugu Govt. don give conditions to re-open sealed shops

 

He yarn say Jonathan dey thread di part of unfairness and injustice. In addition, hin insist say hin actions fit de likened to person wey wan receive salaries from company A after working for company B.

However, Adomekeme express confidence say President Tinubu as a known rewarder of hardwork no go allow a situation of ‘monkey work, baboon chop’.

Also, hin yarn say make pipo no try to reap where dem neva sow. Hin yarn say some of dem don dey there since di early days of this party, when e dey considered to be a taboo just by being a member.

You fit go read di tori see why Bayelsa APC express dia disapproval…READ MORE