fbpx
May 8, 2024

Gas explosion kill 31, injure seven for China restaurant

gas-explosion-for-china-restaurant

At least 31 pipo don kpai and seven get injury for di Chinese city of Yinchuan, for northwest Ningxia region, after gas explosion for China barbecue restaurant Wednesday night, according to state media.

Na leakage from liquified gas tank inside di restaurant na hin cause di explosion, and e happen around 8:40 p.m., according to state broadcaster CCTV.

Among di seven pipo wey injure, one person still dey critical condition. Di other six dey collect treatment for di hospital for minor injuries, burns and glass cuts.

Also, Local fire authorities send 20 vehicles and more than 100 personnel go di scene, with search and rescue operations wey last until 4 a.m. Thursday, according to state media.

 

FOR MORE NEWS: Japa: I support Nigerian wey dey fly go abroad for greener pastures — Peter Obi

 

Photos wey di state media show online display di damaged building, with blackened exteriors, debris wey dey for ground and smoke full di air. Firefighters follow enter di second floor with ladder dey lift pipo out on top stretchers.

Interviews by police and firefighters for di scene find out say restaurant staffers bin smell gas about an hour before di explosion, di Yinchuan government tok dis one inside statement wey dem posted online on Thursday.

Di two staffers see say di valve of the gas tank don broken, and dem send another staff member go buy a new one, according to di statement. Di explosion happen after dem change di valve.

You fit go read tori of di Gas explosion for China restaurant…READ MORE