fbpx
May 18, 2024

Kenyan chef set new world record with 95-hour home cooking marathon

kenya-chef-set-new-world-record

Jubilation don full everywhere for Kenya as Chef Maliha Mohammed set new world record for di longest home kitchen cooking marathon.

Chef Maliha achieve di remarkable accomplishment on Tuesday, August 15, after she cook non-stop for staggering 95 hours, wey surpass di previous record wey American chef Rickey Lumpkin of California bin hold, and na she achieve home cooking time of 68 hours, 30 minutes, and 1 second in December 2018.

Also, di mother of two take to her Instagram page to announce her record-breaking feat after she complete di cook-a-thon.

โ€œYes, we did it! New world record holder for the longest home kitchen cooking marathon in townย ๐Ÿ˜Ž๐Ÿ˜Žย Shukran for the supportย ๐Ÿ’ฏ,โ€ na wetin she tok be dat.

 

FOR MORE NEWS:ย Video of Destiny Etiko and James Brown on boat cruise stir reactions

 

Dis na one of di cooking records wey she plan to break as she bin declare her intention to also break di world record wey Nigerian chef dey hold. Dat Nigerian Chef na Hilda Bassey Essien, also known as Hilda Baci.

Also di Nigerian chef and restauranteur na officially di record holder for di longest cooking time marathon with a time of 93 hours and 11 minutes.

Contrary to reports wey dey fly around, Chef Maliha neva break Hilda Baci cooking record. Di Kenya Chef only set new world record for di longest home kitchen cooking marathon, and Guinness World Record neva confirm am.

You fit go read di tori…READ MORE