fbpx
May 17, 2024

Bolanle Raheem: Police don start brutality, no forget EndSARS – NBA

Bolanle-Raheem

Nigerian Bar Association (NBA) want more details about di fatal shooting of Lagos-based lawyer, Bolanle Raheem. On Christmas day, police officer wey dey attached to di Ajiwe Police Station for Ajah, Lagos kill di legal practitioner.

NBA Publicity Secretary Habeeb Lawal condemn di incident, he mention say police dey go back to dia days of brutality.

Statement by di spokesperson advise di security agency and others make dem no forget wetin cause di EndSARS protest wey shake di nation.

FOR MORE NEWS: Policeman shoot Lagos lawyer Bolanle Raheem on Christmas Day

Lawal say NBA President, Yakubu Chonoko Maikyau (SAN) bin dey on top di situation and hin dey reach out to stakeholders.

He mention say di NBA don take di initiative to uncover di facts wey surround di cold-blooded murder of dia member Bolanle Raheem.

You fit go read more of this tori…READ MORE