fbpx
May 17, 2024

Flood-free Lagos: Govt don reward and open accident insurance policy for EFAG ops

Flood-free-Lagos-

Di Lagos State Government over di weekend don reward operatives of di Emergency Flood Abatement Gang, EFAG, for excellent performance in ensuring flood-free Lagos. Hin advise say make dem dey more committed in di discharge of dia duties.

Commissioner for di Environment and Water Resources, Tunji Bello, talk this one for di end of di Year 2022/Award of Excellence event, wey dem hold for Alausa, Ikeja, Lagos.

FOR MORE NEWS: Christmas tragedy: Accident don kill three pipo for Lagos-Ibadan Expressway

Bello yarn say di government go continue to provide di necessary logistics and moral support wey dem need for better service delivery.

He yarn say di EFAG team wey dem create in 2004 dey do better job in cleaning up secondary drains and manholes for di 20 Local Government Areas and 37 Local Council Development Areas, LCDAs across di state all year round.

You fit go read di full tori…READ MORE