fbpx
May 18, 2024

Policeman shoot Lagos lawyer Bolanle Raheem on Christmas Day

Bolanle-

A lawyerwey base for Lagos, Bolanle Raheem, kpai on gunshot on Sunday.

Police Assistant Superintendent (ASP) na hin kill di Nigerian Bar Association (NBA) member.

Di incident happen near di Ajah bridge on Christmas Day as di deceased bin dey come back from church.

E dey reported say di police shoot Bolanle for inside car wey she bin sit down and her husband bin dey beside her.

FOR MORE NEWS: Fuel: Mass supply go start for Lagos and three others for January

Police Public Relations Officer, Benjamin Hundeyin react to di fatal shooting on Monday.

The spokesman describe di officer action as “unfortunate and avoidable”.

“Di ASP wey shoot and two others with him dey inside custody. Dem go dey moved to di SCID for further investigation”.

Early December, policeman with di Ajah Division open fire kill Gafaru Buraimoh during di raid of black market fuel sellers.

E dey believed say di two killer cops dey attached to Ajiwe Station, a police post wey dey accused of rights abuses and overzealous personnel.

You fit go see di full tori…READ MORE