fbpx
September 16, 2024

Borno Wan Enrol 500, 000 Girls For Public Schools

borno-enroll-thousands-of-girls

Borno State governor, Babagana Umara Zulum yarn say hin administration don enroll thousands of out- of – school girls for di ongoing target of admit 500,000 girls into public primary schools across di state.

Zulum yarn dis one on Tuesday when hin host di United Nations deputy secretary general, Amina Mohammed, alongside Malala Yousafzai, a girl-child education activist and UN peace ambassador for Maiduguri.

Malala Yousafzai, enter Nigeria to commemorate 10 years of her first speech for di UN General Assembly and to celebrate Malala Day.

 

FOR MORE NEWS: Police arrest abductors of Ekiti APC Chairman

 

Every July 12th, di UN dey celebrate Malala Day in honour of Malala Yousafzai. Also, di day fall on her birthday, wey dey fitting to honour her extraordinary life wey she spend to fight for di rights of children and women.

Joining to honour Malala, Governor Zulum tok say girl-child education dey key to address social and economic problems for di long run. In addition, he tok say out-of-school girls dey significantly more than di number of boys wey no dey schools across Borno, and na why di state government dey strongly keen on enrolling girls into schools.

You fit go read di tori see as Borno enroll thousands of girls..READ MORE