fbpx
May 9, 2024

Brazil drop Man United forward Antony over ex-girlfriend assault claim

brazil-don-drop-anthony

Brazil don drop Manchester United winger Antony for di upcoming World Cup qualifying games on Monday following allegations of assault against am by one of hin ex-girlfriend.

Di Brazilian Football Confederation (CBF) tok inside statement say dem drop Antony to “preserve di alleged victim, di player, di Brazil team and di CBF.”

As Brazil don drop Anthony, na Arsenal forward Gabriel Jesus go replace Antony for di squad for di games against Bolivia on September 8 and Peru on September 12.

Antony, 23, on Monday deny say hin physically assault hin ex-girlfriend Gabriela Cavallin inside statement on top Instagram. Hin took say hin be “victim of false accusations.”

 

FOR MORE NEWS: Edo: Oshiomhole, Ihonvbere don win for election tribunal

 

Also, hin yarn say di accusations na lie, and hin tok say di evidence wey hin get, go show say hin dey innocent.

In addition, di denial come after Brazilian press reports publish WhatsApp messages between Antony and Cavallin wey di player allegedly threaten hin ex-partner.

However, inside one of di conversations wey di local media cite, Cavallin yarn say hin must apologize for “kicks and assaults.

Antony for inside Instagram post tok say hin relationship with Cavallin bin dey  “rugged, with verbal abuse on both sides.”

You fit go read di tori…READ MORE