fbpx
May 9, 2024

Transfer: Leicester City want £18m for Iheanacho

transfer-leicester-city-want-18m-for-iheanacho

Leicester City wan sell Kelechi Iheanacho £18m, dem no wan reduce dia price.

As di matter be so, Iheanacho get less than 12 months for hin contract and hin no dey willing to sign extension.

However, Crystal Palace get strong interest for di forward but dem no dey willing to match Leicester City asking price.

Di Eagles value di Nigeria international, Iheanachofor wey Leicester City wan sell for around £10m-£15m.

 

FOR MORE NEWS: Okocha go visit Nairobi with Premier League trophy

 

Roy Hodgson side don line am up as potential replacement for Frenchman Phillipe Mateta, wey dey linked with a move to Bundesliga club, RB Leipzig.

Last last, Leicester City fit no get choice again but to lower dia asking price so dat dem no go lose Iheanacho for nothing next summer.

You fit go read di tori…READ MORE