fbpx
April 26, 2024

BREAKING: Police don deny claims of bomb wey dem plant across Abuja

0
bomb-

Di Nigeria Police Force don deny di talk wey people dey carry about bomb wey dem bury across Abuja.

Force Public Relations Officer, Muyiwa Adejobi na hin publish di statement on Saturday.

DiFPRO mention say e no good as some pipo dey spread false information after di terror alert by di United States, di United Kingdom, and others.

Adejobi yarn say among di pipo wey follow spread di rumor, some peace ambassadors and patriotic agents of national unity for Nigeria follow dey part of dem.

He say as dem dey broadcast di fearful rumors of bomb and as dem dey cause more fear for di Federal Capital Territory (FCT), e no go do di country any good.

Adejobi insist say Abuja dey safe and no threat dey come. On top di matter, hin yarn say bomb no dey anywhere inside FCT as pipo dey talk.

Di police advise residents make dem no mind this fake news wey some pipo dey spread to create fear for people mind.

Di tori dey inside DailyPost…click here make you go read wetin dey happen…READ MORE

For more News: INSECURITY; thy Lord be for us who fit be against us-Buhati to Nigerians

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *