fbpx
April 20, 2024

FG go generate 21 million jobs by 2025

0
Muazu-Sambo.

Di Minister of Transportation, Mu’azu Sambo, don yarn say di Federal Government FG go generate 21 million full-time jobs and dem go lift 35 million people out of poverty by 2025.

For statement by hin Special Assistant on Media and Publicity, Sam Idiagbonya, Sambo announce am on Friday, October 28, 2022, for di ongoing 2022 Ministerial Retreat wey dey Uyo, Akwa Ibom.

YOU GO LIKE READ: Tips to Maintain a Good Relationship with Your Customers

According to am, di transportation sector dey set di stage so that dem go fit achieve di government commitment of lifting 100 million Nigerians out of poverty in 10 years.

Sambo yarn say infrastructural gaps for di sector na hin make am important for di development of di National Development Plans; Medium-Term Development Plans 2021-2025 and a Long-Term Plan wey dem call di Nigeria Agenda 2050.

Di tori dey inside Punch…click here go read di remaining tori...READ MORE

For more News: CBN yarn say Buhari don approve Naira notes redesign

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *