fbpx
May 15, 2024

Broken home, na one of my greatest fear in life – Actress Toyin Abraham

Famous Nollywood actress and producer Toyin Abraham don come out tok say broken home na her greatest fear for life.

While speaking inside one interview with Media Room Hub, di multi-talented actress tok say she no fit imagine say she no dey live together with her husband.

U FIT ALSO READ Bob Marley grandson, Joseph Marley don kpai at age 31

Di movie star tok say she dey constantly pray day and night against “strange” women and men who wan try to destroy pipol marriage no to con pour sand sand for dia gari.

She tok say,“ she no want to ever lose her marriage. She tok say she no wan get failed marriage.

Toyin tok say “ she know say her husband no fit leave her and she too no fit leave husband, base on say na di only fearwey she dey get bi dat.

Na di reason why she dey always pray against any strange women or men wey wan scatter dia marriages. although God ordains am for dem, so there’s nothing to be scared of.

To read di full tori CLICKHERE