fbpx
May 1, 2024

Buhari no go spend extra day for office – SGF, Boss Mustapha

no-extra-day-in-office-for-Buhari-after-hin-tenure

Di Secretary to di Government of di Federation, SGF, Boss Mustapha don assure Nigerians say President Muhammadu Buhari no go spend extra day for office at di end of hin tenure.

Mustapha yarn say despite law suit from di presidential election, Buhari no go spend extra day for office after May 29.

He give di assurance while hin mention say di preparations dey to ensure say Buhari hands over power to di President-Elect, Bola Tinubu peacefully and formally.

Di SGF tok for meeting of di Presidential Transition Committee on Tuesday.

FOR MORE NEWS: Messi don become third player to score over 100 international goals

He yarn say dem dey put things in place to make sure say nothing do di transition.

According to wetin hin tok: “President Muhammadu Buhari no go spend extra day for office after hin tenure for May 29 to hand over power to whoever dey declared by INEC.

In addition, di court processes go continue.  Also nothing go disturb di transition. Even di federal government don issued statement to dat effect.

Also, hin tok say di transition process dey on course and all efforts dey made to ensure say e dey smooth and on May 29, there go be peaceful, formal transfer of power to di President-Elect.”

You fit go read di tori…READ MORE