fbpx
May 22, 2024

Former Lagos LP chairman, Kayode get Bipolar disorder – Rhodes-Vivour

kayode-get-bipolar-disorder

Di Labour Party candidate for di just concluded gubernatorial elections for Lagos State, Gbadebo Rhodes-Vivour claim say di immediate past chairman of di party for di state, Kayode Salako get Bipolar disorder.

Kayode, wey resign hin position in January 2023 to focus on running for di Oshodi Isolo Constituency 1 for di House of Representatives, dey accused of working with di All Progressives Congress, APC.

Remember say Kayode wife, Foluke Daramola  last week, bin tackle Rhodes-Vivour. She accuse am say hin sideline her husband after dem give am party ticket.

Kayode and Rhodes-Vivour don dey for verbal war since di governorship election finish.

FOR MORE NEWS: Buhari no go spend extra day for office – SGF, Boss Mustapha

Inside tweet on Tuesday, Rhodes-Vivour yarn say hin no go trade words with Kayode because hin get Bipolar disorder , and hin claim say hin dey tok out of di influence of hin mental health condition.

He write, “I am very empathetic when it comes to mental health conditions and I do take it very seriously. As a result, I will not be responding to Kayode Salako because I know for a fact that he is Bi-Polar.

“Sadly, this condition is used by others to manipulate him for political gain. I wish him well and hope he gets the medical attention he needs”. Na wetin hin tok be dat.

You fit go read di tori…READ MORE