fbpx
September 29, 2024

“No single government go fit solve Nigeria problems” – Buhari don tok

buhari-yarn-say-no-government-fit-solve-nigeria-problems

President Muhammadu Buhari yesterday yarn say no single government fit solve Nigeria problems.

Buhari, for di state- of- nation dialogue on security, economy and administration of justice for Abuja, yarn say di efforts of successive governments dey required to see di country through challenges.

Although, di hope of di President for di event, organised by di Nigerian Bar Association (NBA), be say e go contribute to Nigeria’s development.

FOR MORE NEWS: President Buhari don pledge to eliminate any wahala wey di currency swap go cause.

Buhari, wey dey represented by di Secretary to di Government of di Federation, Boss Mustapha, remind lawyers say dem owe di nation some responsibilities.

According to wetin hin tok, hin thank dem for restoring di hope of Nigerians. Hin tok say he believe say di bar go provide di necessary leadership. Also, e, he hope say in di course of di discussion, dem go fit bring out playbook wey go provide di guided processes for di incoming regime.

Di summary of wetin Mr Buhari tok for di state- of- nation dialogue be say no single government fit solve Nigeria problems.

You fit go read di full tori…READ MORE