fbpx
May 18, 2024

New Naira Notes: Na Saboteurs dey responsible for shortage – Experts

Naira-Notes-shortage-experts

Economic experts don reacted to di arrest some pipo wey DSS catch as dem dey sell di new naira notes upon di sufferness wey Nigerian dey experience over di new naira notes shortage and scarcity nationwide.

On Monday, Nigeria Secret Security, DSS, di Economic and Financial Crime Commission, EFCC, yarn say dem catch some pipo wey dey  dell di banknotes in exchange for profit for Abuja.

According to a statement on Monday by DSS spokesman, Dr Peter Afunanya, as dem dey di operations, dem follow find out say Commercial Bank officials dey contribute to di economic misconduct.

Also, di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) announce say dem arrest one of those pipo for  Dei-Dei and Zone 4 areas of Abuja wey dey sell di new naira notes for profit.

In addition, di development of di selling of naira notes confirm di fears of saboteurs within di banking system. Na dem dey frustrate efforts to circulate di new naira notes.

According to one financial expert, Mr Idakolo Gbolade  on Monday, hin yarn say saboteurs dey contribute to di new naira notes scarcity nationwide.

FOR MORE NEWS: New naira: Pipo anger don increase scarcity, Reps dey oppose CBN extension

Hin yarn say dem expect di hoarding of di new Naira notes for profit is expected. Di collaboration with bank officials to make profit no make sense at all.

Although measure by di DSS go be as warning to di offenders. If di DSS fit always track these BDCs and syndicates, e go help di nation have more of di notes in circulation for ordinary Nigerians to access.

However, CBN follow get blame for di scarcity of the new notes, and na hin make these syndicates turn am to business.

In addition to wetin di expert tok, hin say CBN need to make di new notes available to all Nigerian even as dem extend di deadline.

Also, one Accounting and Financial Development don for Lead City University, Ibadan, Prof Godwin Oyedokun, called for more action by di DSS to sanitize di industry.

He explain say di CBN  partially get blame for di challenges wey Nigerians dey experience to access di new naira notes, just like experts don tok, and CBN need to do something about di shortage.

Di man yarn say he don know before say 100 per cent fault of di naira note scarcity no come from Central Bank of Nigerian.

You fit go read di full tori…READ MORE