fbpx
May 18, 2024

CBN Don Choose 5 Banks For Cash Swap initiative, but Lagos, Abuja PoS Operators included

cbn-cash-swap-initiative-lagos-Abuja-dey-excluded-

Di Central Bank of Nigeria (CBN) don name about five money deposit banks wey go participate for dia cash swap initiative. This development come as di deadline for di expiration of old N200, N500 and N1,000 notes as legal tender dey approach.

Also, di information bin dey inside di Frequently Asked Questions (FAQ) document wey CBN release on Monday, January 23, 2023. For inside di document, dem put detailed procedure for di cash swap programme.

However, di banks wey dem chosen for di initiative include Zenith Bank, Access Bank, First City Monument Bank, First Bank and United Bank for Africa. Also, di CBN bar PoS operators for Lagos and Abuja from participating for di  programme.

FOR MORE NEWS: New naira: Pipo anger don increase scarcity, Reps dey oppose CBN extension

According to directive by di  CBN, no be all di agents fit participate For Cash Swap initiative.  Di initiative na for only selected agents wey dey profiled by super agents or Mobile Money Operators (MMO) and participating banks.

In addition, bank yarn say selected agents for di states for Nigeria, excluding Lagos and Abuja, fit participate for di programme.  But di other update be say pos agents dey barred from di initiative.

You fit go read di full tori…READ MORE