fbpx
May 19, 2024

Burna Boy replace journalist camera for Paris – Netizens don react say na only outsiders hin dey good to

burna-boy-replace-journalist-camera-for-paris

Burna Boy notice as di camera of one journalist for Paris break. This incident happen as di journalist bin want interview Burna Boy.  As di African giant notice wetin happen, hin tell hin accountant make hin give di journalist money for new camera.

Di matter don make di Grammy award winning singer trend.

According to di report, di young journalist, wey still be intern, mistakenly break her camera as she dey try to interview Burna Boy.

Di camera according to di report worth $2000, na Panasonic GH6.

FOR MORE NEWS: Ini Edo don make her international debut with di production Shanty Town movie for Netflix.

As di matter dey trend, social media users follow react to wetin happen:

@iamjust_fit: “But if Na Nigeria e dey, e no go bother. Oga charity begins at home, no go deh form for outside.”

@hensel: “If na Nigeria now, na him go even kick the camera comot abeg joor.”

@kendra.vall: “All of you shouting if na Nigeria yen yen yen should drink water and rest he no owe Una anything.”

@iam_joyeseyin: “Lmaoo if na Nigeria now, he for don kick person face.”‘

@t_abejide: “Of course it’s in Paris. He wouldn’t do that in Nigeria.”

@jayone: “I can bet my life savings he wouldn’t do same in an African space let alone Nigeria.”

You fit go read di full tori…READ MORE