fbpx
May 4, 2024

Burnaboy shade Brymo inside new freestyle video

burnaboy-shade-hin-colleague-brymo

Popular Nigerian singer and songwriter, Damini Ebunoluwa Ogulu, wey dey popularly known as Burnaboy, don throw shade for hin colleague, Ọlawale Ọlọfọrọ, wey dey popularly known as Brymo, inside recent freestyle.

E neva too tey wey dem accuse Burnaboy say hin thief Brymo song. And BurnaBoy na person wey dey widely recognized nationally and internationally for his unique singing style and stage performances.

Brymo bin mention inside interview with TVC say Burna Boy dey always act like say him be Jesus. Also, na for there hin accuse am of stealing hin song.

 

FOR MORE NEWS: “Child of grace” – Ilebaye receive ₦3.5 million naira cheque and other gifts from fans

 

However, Brymo still express hin frustrations on top his Instagram page. Hin claim say Burnaboy songs, “City Boys” and “I Told Them,” sample di title track of hin unreleased album, “Macabre.

Burna Boy don respond to Brymo for inside new freestyle. For di free style, hin say, “Hustle make you no go fall off like Brymo.”

Di statement now don bring different reactions. Plenty pipo express support for Burnaboy, while some yarn say Brymo deserves anything wey hin get now because e don insult Burna boy too much.

You fit go read di tori see why Burnaboy shade hin colleague Brymo…READ MORE