fbpx
May 17, 2024

Cash crisis: CBN don launch USSD for eNaira on Bullnet

cbn-launch-ussd-enaira-on-bullnet

Di Central Bank of Nigeria CBN don launch di USSD channel of di Central Bank Digital Currency wey dey tagged as eNaira on top Bullnet platform to boost di usage of di platform.

Na for Lagos on Thursday na hin CBN launch di USSD eNaira during an event to discuss di cash crunch. Also, dem tok about how di services introduced by Bullnet on di USSD channel of eNaira go solve di problem.

During the launch, the Chief Executive Officer, Bullnet Bulletin and Enquiries Networking Services, Bayo Akintoye, said the USSD with the code *997*50#,  would soothe the pain felt by Nigerians given the current scarcity of cash as it transitioned from cash-based economy to a cashless one.

FOR MORE NEWS: Air Peace don suspend flight operations for polls

He yarn say di CBN don collaborate with Chamsmobile Limited (a CBN licensed Mobile Money Operator and Super-Agent) to address challenges wey unbanked pipo dey face, di underserved and di ones wey dey di other side of di digital divide by developing di service known as ‘eNairaeNhanced Services’. This na via di eNaira USSD channel (*997*50#) wey dey fully run and powered by di Bullnet Platform.

E dey expected say Nigerians go proudly associate with this innovation and register to have di eNaira wallet. These wallets fit dey fund with cash directly with cash-purchased vouchers (like the GSM recharge cards) or from funded bank accounts. Also, pipo go use bank cards via di web portal or use electronic payment with any authorized agent.

You fit go read di full tori…READ MORE