fbpx
May 17, 2024

Banks go close branches early ahead of polls

banks-go-close-branches-early

Deposit Money Banks don announce say dem go close dia branchses early on Friday, a day ahead of di presidential polls wey go hold nationwide on Saturday.

For inside notices wey di banks issue to dia customers, di banks yarn say dem go close earlier than dia 4:00 pm official closing time.

However, di banks advise dia customers make dem use dia alternative banking solutions such as USSD, mobile apps etc.

First Bank for inside dia notice to customers as make dem kindly dey informed say dia branches nationwide go close to customers earlier than usual on Friday, 24 February 2023 by 1:00 pm.”

Stanbic Bank for inside email address dia customers say make dem dey informed say dia branches go close by 1pm on Friday, 24 February 2023.

FOR MORE NEWS: Cash crisis: CBN don launch USSD for eNaira on Bullnet

Also, di banks yarn say dia customer contact centre no go dey available on Saturday, 25 February and Sunday, 26 February 2023 to attend to calls and requests because of di election.”

Also, Access Bank go close early by 12 noon.

Inside circular wey dem publish on Thursday via email to customers, banks say dia branches go close early on Friday, February 24, 2023, at 12 noon. This na to allow for di timely departure of customers and staff to dia respective locations in preparation for di 2023 general elections wey dey planned for Saturday, February 25, 2023.”
You fit go read di full tori…READ MORE