fbpx
May 4, 2024

CBN move to collect bank consumers’ data no dey necessary – NDPB

cbn-to-collect-customers-data

Di National Commissioner of Nigeria Data Protection Bureau, a

Olatunji tok dis tori on Monday during an interview on top Channels Television.

Remember say CBN mandate banks to collect customers’ social media handles for di latest Due Diligence Regulations 2023 report.

Olatunji tok say di newly signed Data Protection Act by President Bola Ahmed Tinubu na to protect di privacy rights of all Nigerians.

 

FOR MORE NEWS: Lagos-Ibadan expressway: FG don suspend further work till July 3

 

Hin tok say di whole idea of data protection law na to protect all the rights, freedom and interest of Nigerians wey be data subjects.

Also, hin yarn say dem don write letter to di Central Bank of Nigeria concerning di new regulation wey mandate banks to collect customers’ social media handles for identification.

In addition, hin yarn say If that one must happen under public interest, some guidelines dey wey dem must follow.

Also, hin tok say e get way wey banks go need to informing dia customers on di reason for data collection.

On June 14, Tinubu sign di Data Protection Act to provide a legal framework for protecting individuals’ personal information.

You fit go read di tori see more gist why CBN wan to collect customers data…READ MORE