fbpx
May 18, 2024

Lagos-Ibadan expressway: FG don suspend further work till July 3

Federal-Government-suspend-reconstruction

FOLLOWING public outcry over di chaotic traffic situation for Lagos-Ibadan expressway, di Federal Government, yesterday, suspend further work on di ongoing reconstruction.

Di Federal Controller of Works for Lagos, Mrs Olukorede Kesha, inside statement, yarn say di suspension na to reduce possible gridlock during di Eid-el-Kabir celebration wey go hold for Wednesday and Thursday.

Di contract for di reconstruction dey awarded in 2013 by di Goodluck Jonathan administration for N315 billion.
So far, di Federal Government don approve about N240 billion for di reconstruction of di Lagos-Ibadan Expressway, out of a total of N315 billion wey be di project contract value.

 

FOR MORE NEWS: Confusion as NERC continue to review electricity tariff

 

Also, di highway, wey work don stop for some time, connect Lagos, Ogun and Oyo states, and e leads to various regions of di kontri.

Di Federal Government bin initially make a concession agreement with Wale Babalakin’s Bi-Courtney to rebuild and manage di road for 25 years, but after di company fail to make any progress, di Federal Government, on November 19, 2012, terminate di contract.

As a result, former President Goodluck Jonathan administration, in July 2013, flag off di reconstruction of di highway and hin award di project to Julius Berger Nigeria and Reynolds Construction Company Nigeria at a cost of N167 billion with a completion period of four years.

You fit go read di tori see more gist on why Federal Government suspend reconstruction for Lagos-Ibadan expressway…READ MORE