fbpx
May 18, 2024

Celebrity deaths wey shake entertainment industry

Celebrities-wey-kpai-for-2022-entertainment-industryv

Some great celebrities for di entertainment industry kpai well well for 2022. Di death of gospel musician, Sammie Okposo na hin be di latest.

Di entertainment industry wey don produce great icons for 2022 face death of young and energetic entertainers wey bin display exceptional talent.

Some of di veterans lose dia lives either from unforeseen circumstances or chronic illnesses.

FOR MORE NEWS: Man celebrate hin mama as she graduate from university 20 years after she drop out to take care of am

Sammie Okposo, popular gospel singer kpai on November 25, 2022. Di ‘wellu wellu crooner kpai as hin dey sleep for hin house wey dey Lagos State. Dem bury am for one private cementary wey dey Ikoyi.

Di death of Osinachi Nwachukwu shock di world after dem report say di ‘Ekwueme singer’ kpai of domestic violence. Osinachi unfortunate death happen after dem report say her husband beat her.

Report talk say hin kick her for chest wey land her for hospital. Another report yarn say na throat cancer kill Osinachi but her family talk say na lie. Di matter dey court.

Dem bury di mother of three June 25, 2022, while her husband still dey custody.

You go like read di full tori…READ MORE