fbpx
May 4, 2024

“Na my pastor pay for everything, I just cook” – Chef dammy don reveal details about her controversial cook-a-thon

chef-dammy-cooking-marathon-2

Chef Dammy don come front drop details about di funding for her most recent cooking marathon.

Di 120-hour cooking marathon wey start on Friday, June 9 bin generate plenty interest and rumors.

In response to di accusations, Chef Dammy post message on top Twitter.  She claim say di event financial organizers na her pastor and churchgoers.

She make ama clear say she just be di project public face.  Also, she yarn say she bin no dey directly involved for di fundraising procedure.

Also, she express disappointment as pipo no gree focus on di capital investment wey dem use launch di program, instead, critics focus on the money wey pipo raise during di marathon.

 

FOR MOR NEWS: “Make una no vex too much”- Ruby Ojiakor don finally bow to pressure, she tender apology to Destiny Etiko

 

As she dey address di rumors wey surrounding her pastor involvement for di proceeds from di cooking marathon, Chef Dammy deny di allegations.

She advicepipo make dem stop to dey spread false information, and she tok say more than half of di funds generated still dey her personal account.

Dammy clarify say di total amount wey she receive neva pass di initial investment wey dem make to establish di event.

You fit go read di tori of Chef Dammy cooking marathon…READ MORE