fbpx
May 18, 2024

Guinness World Records don tok dia own on Chef Dammy 120-hour Cook-a-thon

chef-dammy-cook-a-thon-gwr-break-silence-

Guinness World Records, GWR don finally break dia silence on top di matter of Nigerian Chef Dammy 120-hour cook-a-thon.

 

Di young lady, wey dey known as Chef Dammy from Ekiti State, start to trend on top social media after she embark on a 120-hour cooking marathon, attempt to break di record of Nigerian chef Hilda Baci, wey currently holds the world record for di longest cooking time by an individual.

However, her decision to challenge Hilda Baci record spark mixed reactions and e cause widespread debate on top social media.

 

FOR MORE NEWS: “120-hour cook-a-thon not for Guinness World Record” – Chef Dammy don tok

 

On Wednesday morning, June 14, Chef Dammy reach her target of 120 hours, and e make plenty pipo dey wonder weda Guinness World Records go approve her accomplishment.

To clear di air, Legit.ng send press inquiry give Guinness World Records on Tuesday, June 13.

Di response received from di organization suggest say di chef no ask for dia approval before she begin di cook-a-thon, as dem get procedures and rules wey dem go send give her make she for follow.

You fit go read di tori as GWR break silence on Chef Dammy cook-a-thon…READ MORE