fbpx
May 18, 2024

“120-hour cook-a-thon not for Guinness World Record” – Chef Dammy don tok

chef-dammy-cooking-marathon

Viral Ekiti chef, Damilola Adeparusi, wey dey popularly known as Chef Dammy, don reveal say her just-concluded cooking marathon no be attempt to break di Guinness World Record.

Di young Chef Dammy wey just complete her cooking marathon make dis revelation inside chat with BBC Yoruba. Dis na after she successfully reach her target of 120 hours.

Chef Dammy, wey be undergraduate from Ekiti State, gain viral attention on top social media when she embark on an extraordinary feat of cooking continuously for 120 hours.

 

FOR MORE NEWS: JUST-IN: Again, Inflation Don Rise To 22.41%

 

Also, plenty pipo bin don think say her effort na attempt to pass Nigerian chef Hilda Baci record for di longest cooking time.

However, during her interview with di BBC, Chef Dammy make am clear say na personal challenge for herself. In addition, she yarn say she do am because of her love for cooking.

“I did it because I enjoy cooking. I didn’t do it to be recognized by the Guinness World Record or to break Hilda Baci’s record,” Na wetin she tok for Yoruba be dat.

You fit go read di tori…READ MORE