fbpx
April 25, 2024

Christmas: Police don ban firework (Banger)

0

Di Nigeria Police Force, Zone 5, don ban di use of fireworks (banger) within the zone during and after Yuletide.

Di AIG in charge of di zone, comprising Edo and Delta, Lawan Jimeta, yarn dis one for one statement by DSP Tijani Momoh,wey bi Zonal Police Public Relations Officer (PRO), on Saturday for Abuja.

U FIT ALSO READ Fuel tanker catch fire for Abuja

According to Jimeta, di devices too dey explosive and e fit cause harm to lives and properties as well disturb di peace of di publics and also cause unnecessary panic to di pipol wey dey reside for di Area.

Di zone don alreadi appeal to di general public, parents and guardians say make dem no try to engage in buying or lighting dis devices
PRO tok say Parents must encourage and warn dia children against di buying or use of fireworks (banger).

Police don warn those pipol wey dey sell am say,dem no wan see say dem sell firework (banger) give anybody or group of pipol.

Dem tok say if dem see anybody wey go against di order or dem hear anything like “pah or pah pah” na police form china go arrest everybody.

Di AIG also don use dat medium to extend hin Yuletide greetings to al di Christian faithful and others for di zone as they celebrate Christmas.

Hin don give assurance to all di pipol wey dey reside within di zone dat di zonal command don guarantee di safety and security of lives and properties throughout di festive period.

Jimeta tok say if dem see any kurukere waka of anybody make dem shapali report to di nearest Police Station.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *