fbpx
April 20, 2024

Fuel tanker catch fire for Abuja

0
tanker-fire

Tanker wey carry Petrol, catch fire as dem dey deliver fuel to one Conoil station for di Area 10 of Abuja.

Eyewitnesses yarn say di fire start around 3:35 pm on Saturday afternoon, as di tanker bin dey try to offload wey e carry. Na so some fuel pour for ground.

As di matter be now, dem neva report say di tanker fire don kpai person, but fire affect some cars wey dey their, some of dem burn.

YOU GO LIKE READ: The 7-Step Customer Management Plan for Boosting Sales and Retaining Customers

As of the time wey dem file this report, officers of the Nigerian Police and Federal Road Safety Corps, don block traffic to the area. While men of di Federal and Army Fire Service battle to quench di fire wey dey burn.

Dem yarn say we go get more details later….READ MORE

For more news: Man declared missing after hin attend programme for Redemption Camp

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *