fbpx
May 18, 2024

Christmas tragedy: Accident don kill three pipo for Lagos-Ibadan Expressway

Accident-kill-three-pipo

Three pipo don kpai and six others sustain injury for accident wey happen on Christmas day for di Lagos-Ibadan Expressway.

Di accident happen around 5.50am for di Kara turning point of di highway for di  Obafemi-Owode Local Government Area of Ogun State.

FOR MORE NEWS: Nigerians dey on low key because of fuel crisis and harsh economy

Di Public Education Officer of di Federal Road Safety Corps for Ogun State, Florence Okpe, confirm di accident for statement on Sunday.

Okpe yarn say 18 pipo wey be male adults get di accident because of speed and wrongful overtaking.

She explain say di two vehicles wey dey involved for di accident na Toyota Haice bus with registration number AYB 88 XP and another vehicle with no registration number.

You go like go read di full tori…READ MORE