fbpx
May 18, 2024

Police don arrest bandit, recover 4 AK-47 rifles for Kaduna

Di Police Command for Kaduna State, don arrest one bandit/gun runner and dey don recover four AK47 rifles with 344 rounds of ammunition and motorcycle for Kaduna.

Di Command Police Public Relations Officer (PPRO), Muhammad Jalige, confirm di arrest inside one statement issued on Sunday for Kaduna.

U FIT ALSO READ  Christmas tragedy: Accident don kill three pipo for Lagos-Ibadan Expressway

Hin tok say on Dec 23, around 17:30 hrs, police operatives wey dem attach to Tudun Wada Zaria, during one patrol for Kwarkwaron Manu, Basawa area of Zaria arrest two men ontop one unregister motorcycle.

Di motorcycle and di rider, wey hin name bi Bilyaminu Saidu, na 33 years old from Shuwaki village, Bakori LGA of Katsina State,
Bifore di search di police operatives stop di bike on di road as dem tok say dey wan wan search di motorcycle di passenger jump down and hin run away.

Items wey dem recover from am include four AK47 rifles, 344 rounds of 7.62mm live ammunition, telephones and charms.

Di PPRO don come out appreciate all di support and cooperation of di Police and other security agencies.

To read di full tori CLICKHERE