fbpx
May 19, 2024

Presidential tribunal: Over 100 Nigerians sign petition dey demand justice

concerned-nigerians-don-sign-petition

Over 100 concerned Nigerians don sign petition to demand justice and transparency for di ongoing presidential electoral tribunal proceedings.

According to report, di move come because of di concerns over di claim of electoral malpractices during di February 25 presidential election, wey bring di legitimacy of di results to question.

Di petition by di Coalition of Concerned Nigerians, CCN, wey dem address to several justices, highlights di frustrations and worry wey dem for di electorate.

Also, di petition address Hon. Justice Haruna Tsammani, leader of di 5-man panel wey dey handle di presidential election petitions.

Di Coalition of Concerned Nigerians CCN  dey beg di judge say make dem strictly abide by di constitution of di Federal Republic of Nigeria, wey dem swear loyalty too.

 

FOR MORE NEWS: Lecturer use fingerprint scanner take class attendance

 

Also, dem dey call upon di judges make dem prioritize di welfare and interests of our great nation above any individual concerns.

In addition, dem tok say e dey important note am say di invited and accredited election observers, like di European Union mission, don presented detailed reports wey highlight plenty errors before, during and after di elections.

Di Coalition dey try tell di Tribunal say make dem consider those vital pieces of evidence and make dem apply law with objectivity and fairness.

You fit go read di tori see why Concerned Nigerians sign petition…READ MORE