fbpx
May 19, 2024

Two white garment church members drown for Ogun river

two-boys-drown-for-ogun-river

Tori confirm say two boys kpai for Ifo General Hospital after dem drown for river wey dem go swim for Ogun state.

Di two pipo bin travel from Lagos go Cherubim and Seraphim Church for Onikoko via di Itori neighborhood of di state. All dis tori dey statement wey come out on Tuesday from Omolola Odutola, di public relations officer for di Ogun State Police.

Also, from di statement, di PPRO tok say one member of di church, one Adebayo Adeosun, report for di station around 6.30pm say some boys wey come from Lagos on August 27, 2023, for hin church inauguration, comot for di church premises go swim, and na for there di boys drown.

 

FOR MORE NEWS: Just IN: Gabon president call for help after dem put am under house arrest

 

However, na after person manage rescue di body of di victim na hin di victims kon dey identified as Tunde Falade (35) of Kola Alagbado, Lagos, and Femi Akinola (32) of Odo Eran, Itire, Lagos State.

Di ambulance for di area na hin go carry di body go di Itori Health Center, where one working doctor confirm say di boys don kpai.

In addition, after receiving di report, Odutola add say di Divisional Police Officer, CSP Olayemi Jacob, send hin team go di scene to investigate.

Also, di DPO reach there, hin tok say hin no see say signs of violence and foul play for di river where di two boys drown.

You fit go read di tori…READ MORE