fbpx
May 19, 2024

Tinubu don order recapture of inmates wey escape

tinubu-order-re-arrest-of-inmates

President Bola Tinubu don order for di re-arrest of inmates wey escaped from prisons for di kontri between 2021 and 2022.

Di Minister of Interior, Bunmi Tunji-Ojo, wey reveal dis tori for briefing wey dem hold for Abuja on Wednesday, yarn say di president want make dem recapture di inmates wey escape as quickly as possible.

Between 2021 and 2022,  seven attacks happen for prisons across di country and large number of inmates escape.

Atleast 4,000 inmates na hin escape from di seven prisons, including Kuje, Kogi, Jos, Abologo, Owerri, Okitipupa, and Oko prisons.

 

FOR MORE NEWS: Presidential tribunal: Over 100 Nigerians sign petition dey demand justice

 

Di minister, wey reveal dis update after hin go inspect di facilities for di Nigerian Immigration Service and Nigerian Prisons Service, yarn say di service go work hard to ensure say dem folloe di order wey di president give about inmates wey escape.

Also, hin yarn say Nigerian Prisons Service go work in collaboration with security agencies for di kontri to recapture dem.

Tunji-Ojo yarn say di president don give dem matching order to recapturing di inmates wey escape. Also, dem go work with other security agencies to achieve dis. Hin tok say dem go work round di clock, also, dem go make suere say di ones wey dey inside no go out.

In addition, hin yarn say acts of sabotage go go dey tolerated from prison officers.

You fit go read di tori…READ MORE