fbpx
April 26, 2024

Continuity of past administration projects na one of my priority – Gov. Adeleke

0

Ademola Adeleke wen bi di newly elected governor of Osun State, don come out talk say, hin administration no go abandon uncompleted projects of previous administration inside di state.

Governor Adeleke tok say hin readi to maintain good relationship beetwin di Executive and di Legislature to move di state forward.

U FIT ALSO READ Osun inauguration: Ademola Adeleke don take over office as di sixth executive governor of di state

Di governor yarn dis one on Monday for Osun State House of Assembly wen him go visit di legislators to discuss mattar on how dem go take move di state forward.

“Hin tok say now wen election matta don comot, him want everybody to join hand with am to move di state forward; hin tok say only him no fit run di government alone.

“Di governor talk say hin administration no go cheat on anybody at all at all, peace go dey and everybody go dey jolificate.

Di Speaker of house of assembly tok say di legislative and executive arms of government must strengthen dia communication channels to communicate effectively, to avoid fake news and rumour.

To read di full tori CLICKHERE
.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *