fbpx
April 29, 2024

APC NEC: Confusion over Adamu reported resignation

Controversy-over-adamu-resignation

Controversy don full everywhere over di reported resignation of Abdullahi Adamu, di National Chairman of di All Progressives Congress, APC.

Adamu reported resignation don bring plenty tok since Sunday night, but confirmation neva come out from di party or di Progressives Governors Forum.

But according to Daily Trust, Adamu tender hin letter of resignation on Sunday night.

Di report quote one source wey tok say di party chairman send hin resignation letter to di Presidential Villa, Abuja.

Also, di resignation letter bin dey submitted to di Chief of Staff of di President, Femi Gbajabiamila, around 4pm on Sunday.

 

FOR MORE NEWS: Presidential election: No cancel our victory over 25 percent for FCT – Tinubu, Shettima dey beg tribunal

 

Di National Executive Committee and National Caucus of di APC dey scheduled for July 18 and 19, 2023, for Abuja.

Also, di party dey expected to hold a National Working Committee, NWC, meeting ahead of di NEC.

E don tey wey Adamu get running battle with di National Vice Chairman, North West, of di party, Salihu Lukman.

Lukman, among corruption allegations, follow accusing Adamu of breaching di constitution of di party and running a sole administratorship.

Hin accuse di Adamu leadership of squandering di 30 billion wey dem make during sales of forms for di 2023 elections.

Dis na di tori wey dey, you fit go read am see di Controversy over Adamu resignation…READ MORE