fbpx
April 27, 2024

Mohbad: Court don remand Naira Marley, Sam Larry, and 2 others

court-remand-naira-marley

One Sabo, Yaba, Chief Magistrate Court, yesterday, remand Abdulazeez Fashola, also known as Naira Marley (32), and three others for di claim of conspiracy in di murder of singer Oladimeji Aloba, wey pipo sabi as Mohbad.

Di other pipo wey dem remand na Ogedengbe Fisayo (37), Ayobami Sadiq (27), and Samson Eletu, wey pipo sabi as Sam Larry (45).

Chief Magistrate, Mrs. Adeola Olatubosun, order di remand for 21 days inside police State Criminal Investigation and Intelligence Department, SCID, and dem adjourn di case until October 25.

Also, she give order say make di suspects get access to medicals and lawyers of dia choice.

As di matter be so, di suspects dey charged with conspiracy and suspected murder.

 

FOR MORE NEWS: Chicago State University: Tinubu certificate no be fake – Presidency

 

Earlier, DSP Umaru Bello and ASP Augustine Nwabuisi, wey lead di legal team for di Police, advise di court say make dem remand the men for 30 days, to prove say dem commit offence.

Police declare Prime Boy wanted

Besides, di Police for Lagos don declared Owoduni Ibrahim, wey pipo sabi as ‘Prime Boy’, wanted in connection with di investigation into di death of Mohbad.

Also, dem offer N1 million bounty to anybody wey go get useful information to hin arrest.

Court remand Naira Marley, You fit go read di tori…READ MORE