fbpx
May 5, 2024

Chicago State University: Tinubu certificate no be fake – Presidency

tinubu-certificate-no-be-fake

Di Presidency don insist say di certificate wey President Bola Tinubu present to di Independent National Electoral Commission, INEC, no be fake.

Tinubu Senior Special Assistant on Media and Publicity, Temitope Ajayi, yarn say di Chicago State University confirm am say di president no submit fake result to INEC.

Ajayi note am say CSU declare under oath say Tinubu attend and hin graduate from di institution and say di school no dey handle replacements for lost certificates.

 

FOR MORE NEWS: Basketmouth na di most wicked and oppressing comedian” — Bovi

 

Also, hin yarn say truth no dey for di forgery claim, andhin add say nobody fit forge certificate wey dem already get.

Following petition by di presidential candidate of di Peoples Democratic Party, PDP, Atiku Abubakar, CSU released Tinubu academic records on orders of di court.

And, na Atiku bin request for di documents to back hin allegation of forgery against Tinubu.

However, di allegation of forgery na one of di cas were dey dismissed by the presidential election court for di suit wey  Atiku file to challenge Tinubu election.

Tinubu certificate no be fake, You fit go read di tori…READ MORE