fbpx
April 27, 2024

Abule-Egba flyover: Communities dey beg Sanwo-Olu over roads damage by construction

communities-dey-beg-sanwo-olu

Communities for new Oko-Oba and Abule Egba for Lagos State dey beg Governor Babajide Sanwo-Olu make hin go fast repair di  roads wey spoil during di construction of Abule Egba Flyover by di past administration of Akinwumi Ambode.

However, di communities inside letter to di governor, bin list some of di roads and streets to include Jibowu Road, Sanni Balogun, Karaole/Adetoun, Olu Ajayi/Majek, Sule Abiodun, Agbe Road, Ile Ogbo Street, Bayo Aderinye Street, Funmilayo George Street, Agent Temple, Alhaji Ashafa, Paul Street, Segun Akinola, Arowolo, among others.

 

FOR MORE NEWS: Presidential matter: Tinubu, Atiku, Obi, APM don begin battle for Supreme Court

 

Di Baale of Karaole Ojokoro Land, George Dada, on behalf of di communities yarn say di pipo of new Oko-Oba, Abule Egba, wey be fast developing area of Lagos, remind Sanwo-Olu of di challenges and hardship wey di construction of the Abule Egba Flyover cause in record time.

As dem dey congratulate di governor on hin re-election, Dada yarn say di “Former Governor, Akinwumi Ambode bin personally come dia  communities,  and hin assure dem say di government dey aware of di hardship and discomfort wey dem go face for di period of di construction.

Also, Inside di letter wey communities dey beg Sanwo-Olu, dem yarn say nobody don come assure dem say dem go do something about di road or repair any of di affected streets.

You fit go read di tori…READ MORE