fbpx
May 6, 2024

Cross fall for Davido concert stage, fans dey shout ‘colos.’

cross-fall-from-stage

Cross Okonkwo, wey be former Big Brother Naija ‘All-Stars’ Housemate, scatter ground as him fall from stage while dey perform for Davido show. For di video wey dey everywhere, Cross bin dey sing with joy to di fans before e fall yakata from di stage.

Plenty pipo for social media believe say na because of di too much excitement wey Cross get for him mind dey perform for Davido concert, na im cause di fall. But so far, nobody don yarn say e get serious injury as e land for ground.

See wetin some pipo talk for comments below di video:

 

FOR MORE NEWS: INEC don promote 5,196 workers.

 

@Saleey: “E fall like metro too much 😂.”

@King_jmms: “Cross too dey do grag grag too much 😂.”

@Nikel: “This kind fall fit just make person laugh anyhow 😂😂😂😂😂.”

@its_sheeda: “Everybody just dey fall for stage these days 😂😂😂 Hope no be colos sha 😂😂.”

@Guiltysand: “Him village people don finally locate am.”

@Franco_logistic: “E fall like metro too much, nobody even yarn am sey e dey do pass 😄.”

@Oops_girls: “E never even enta music industry well, e don fall 😂 Hope say e no wound too much?

You fit go read di tori see videos as Cross fall from stage…READ MORE