fbpx
May 5, 2024

“I no fit serve god wey no fit wake up people like Mohbad and Osinachi,” na wetin Daddy Freeze yan.

daddy-freeze-no-fit-serve-god

The controversial media personality, Daddy Freeze, don talk say he no fit serve God wey no get power to bring back people wey don die, like musicians Mohbad and Osinachi.

E yan dis one for social media, and e no dey di first time wey Daddy Freeze go talk something wey go spark debate.

This comment from Daddy Freeze follow as Pastor Enoch Adeboye yarn about one miracle wey God do for am sake for America. Pastor Adeboye talk say dem invite am go program for Colorado, America, during winter.

 

FOR MORE NEWS: “It’s my turn to conquer” – Rema yan Burna Boy for 02 Arena stage.

 

Because the pastor no like cold, e pray to God make winter stop for di time wey e dey there. As Pastor Adeboye talk dis one, Daddy Freeze don use im page yab the man of God. Daddy Freeze talk say e no fit serve God wey no fit save young artists like Mohbad and Osinachi. E still talk say e no go fit serve god wey go watch im children, wey dey pay tithe, dey suffer hunger and penury because naira fall.

You fit go read di tori…READ MORE