fbpx
May 9, 2024

Dangote group deny cement price slash

dangote-deny-cement-price-slash

Dangote Group don deny claims about di price slash of Cement to N2,700 per 50-kilogramme bag from N5,500.

Anthony Chiejine, Spokesperson for Dangote Group, reveal dis tori Monday.

Chiejine describe di claim as fake news.

“It is fake news”, na wetin hin tok be dat wen dem ask am.

Hin reaction come dey come inside di matter of di rumour of Dangote group wey crash cement price by 50 per cent with effect from October 1st, 2023.

Earlier, Bahir Ahmad, media aide to former president Muhammadu Buhari, bin comment say di report na fake.

Ahmad tok dis tori through hin official X handle on Sunday.

 

FOR MORE NEWS: 80-year-old man kpai inside Kano well

 

As e be so, di Dangote Group don tok say di trending reports about di reduced price of cement from N5,500 to N2,700 effective October 1st na lie.

Di price of one 50kg bag of cement dey between N4,600 to N6,000 for Lagos, Ogun, Ondo and Abuja.

However, two weeks ago, BUA Cement bin take stly tok say dem plan to reduce di price of a 50kg bag of cement to between N3,000 and N3,500.

BUA chairman, Abdul Samad Rabiu tok dis one after meeting with President Bola Ahmed Tinubu.

Dangote group deny cement price slash, You fit go read di tori…READ MORE