fbpx
April 26, 2024

Dangote, Elumelu, Jim Ovia gather join as Tinubu present Economic Blueprint

0

Bola Ahmed Tinubu wey be Presidential candidate of the All-progressive Congress (APC) sit-don with top Business leaders from different sector for Naija economy to present wetin the Oyinbo people dey call “economic blueprint”, wey be document wey dey show how him be wan arrange Naija economic if he become Naija President for next year election.

The event wey be talk make I talk take place for Lagos inside Eko Hotel and Suites wey dey Victoria Island Lagos.

Among Business Mogul wey sit-don for the event na, UBA Chairman, Tony Elumelu, Zenith Bank Chairman, Jim Ovia, Alhaji Aliko Dangote, and Sen. Kashim Shettima wey be Tinubu running mate and APC Oga dem.

You go like read: Elon Musk don reduce Twitter verification fee to $8

According APC Presidential Candidate Asiwaju Bola Ahmed Tinubu, he talk say Nigeria no hin go join other wey make Nigeria become country wey be one sector economy, say plenty things dey wey government and private sector gather join hand do to reduce joblessness, scarcity, under development and hardship wey dey the country.

Plenti things dey wey e talk for the summit…click here to enjoy the full tori …I dey here

 

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *