fbpx
May 5, 2024

Desmond Elliot vs youth: Lagos Youths Vows to Deal with Desmond Elliot for Upcoming State Elections

youth-vow-to-deal-with-desmond-elliot-in-Lagos-elections

Surulere youth for Lagos don vow to come out in mass to vote out actor cum politician Desmond Elliot, during di upcoming state elections from hin political post as lawmaker of di Lagos State House of Assembly, Surulere Constituency.

Di youth still dey angry because ever since Desmond Elliot enter office on 11 April 2015, he neva produced any positive outcome, especially for Surulere. To make matters worse,  he turn hin back on di youth during di END Sars protest in 2020. Dis na as hin by push for bill to regulate and control speech on social media for di Lagos State house of assembly.

However, as di case be now, di youth for Lagos don ready to deal with Desmond Elliot for upcoming elections.

Now as dem ready to deal with him, di youth don throw dia weight behind Labour Party’s candidate and actor, Olumide Oworu wey dey set to contend with hin senior colleague, Desmond Elliott to represent Surulere Constituency for Lagos House of Assembly.

FOR MORE NEWS: “Na di pattern be dis”- Netizens don react to claim of JJC Skillz wey move go hin new wife house for Abuja

Desmond Elliott don dey in seat of power for two terms and hin dey consider to run for third time, however, dis time, hin get opponent to contend with for hin seat for Lagos State House of Assembly, Surulere Constituency.

Hin junior colleague, Olumide Oworu declare hin interest to contest for hin position by sharing a flyer and a lengthy post to run for Desmond Elliott position.

Olumide, wey want change, for hin official statement announce hin declaration, and hin reveal hin passion for youths and service to Nigerians.

Also, hin yarn say di youth of dis generation for Nigeria dey more politically aware than ever. And now youths dey striving to make dia voices heard and take part for di government process of dis great kontri.

You fit go read di full tori…READ MORE