fbpx
May 18, 2024

This country economy go suffer as CBN no gree shift di deadline – EXPERTS

di-country-economy-go-suffer-if-cbn-no-extend-di-deadline-

Economic expert don tok say if CBN no extend di deadline to phase out old naira notes,  di country economy go suffer.

As expert make this call, other stakeholders don make di cal too. Di national Assembly follow tok about di deadline for old naira notes to remain legal tender. Dem dey tok say di country economy go suffer if CBN no extend di deadline.

Last month, December, di Senate bin tell CBN say make dem shift di deadline from 31 January to June. Di upper chamber follow made di call.

But, di speed wey di apex take implement naira redesign policy in less than three months don make pipo dey wonder , and di fear of real crisis don increase.

FOR MORE NEWS: Banks dey battle shortage of new naira notes ahead of deadline

Although, Dr Muda Yusuf wey be CEO of Centre for Promotion of Private Enterprise, CPPE, yarn say e dey insensitive if CBN insist on di 31 January, 2023, deadline.

According to am, di apex bank needs to dey more realistic about di deadline.

Di CEO tok say if CBN no extend di 31 January deadline, dem dey infringe on citizens fundamental human rights.

Mr Idakolo Gbolade wey be financial expert yarn say CBN 31 January deadline no dey possible.

Di new naira note neva circulate everywhere, and e be like say di quantity no dey enough, CBN suppose know say dem need to extend di date for some reasonable days.

You fit go read di full tori…READ MORE